Get Even More Visitors To Your Blog, Upgrade To A Business Listing >>

just laff

s
TOO MUCH GRAMMAR DEY CAUSE TROUBLE O...
I enter this Cross- Country bus from Abuja to
Benin yesterday.
As we dey go for road one man for back say
'driver I am impressed.' The driver com say
'thank you sir.'
We never reach Lokoja wen the man tell driver
again, 'driver I am impressed.'
The driver come thank the man again.
Before we comot for Lokoja the man don thunder
again say, 'driver I am impressed.' The driver
come say, 'thank you very much sir, I very much
appreciate your compliments.'
The driver begin dey fire the bus dey go come dey
feel like James Bond.
As we reach Okene the man shout 'driver stop
this bus, stop this bus, you mad, you wan kill
person?'
As driver stop the bus the man run comot like
Usain Bolt enter bush.
We rush follow the man make we see wetin dey
impress the man.
Before we reach where the man dey we hear pra
pra pratata pro pro!
Na there we come realise say wetin the man wan
tell driver be, 'driver I am pressed'
I take God beg all of una...
If the English hard small, una fit talk am for
pidgin.
Meanwhile... I' m impressed right now, make I
rush discharge... I dey come



This post first appeared on 9jastylists, please read the originial post: here

Share the post

just laff

×

Subscribe to 9jastylists

Get updates delivered right to your inbox!

Thank you for your subscription

×